COVID-19 Vaccine Confidence
Social Media Messages in Nigerian Pidgin English
After the rapid development of the COVID-19 vaccines and subsequent rollout, there has been an infodemic of misinformation circulating about COVID-19 vaccine safety and efficacy, reducing public trust in getting vaccinated. This social media toolkit aims to support MOH officials, frontline health workers, community leaders and members, and patient advocacy groups with key messages to help address COVID-19 vaccine hesitancy in their communities.
This toolkit is also available in Swahili, Luganda, and English.
Hashtags
#Vaccines Work #GetVaccines #VaccinesSaveLives #COVID19 #YesToCOVID19Vaccine
Social Media Messages
To Protect Community pipu (and Yasef)
If you never catch COVID, my brother your own better o. If you no want make you and your family dem, to catch COVID, go collect injection wey dem dey call vaccination. Na this vaccination go protect you and your family. Go hospital to collect the vacinnation. You fit go MOH or NPHCDAdem website to see the informate.
To collect the vaccine go keep your family pepo safe from COVID-19.The hospitu go fit help you check the National Primary Health Care Development Agency (NPHCDA) website for wetin you and your family go need.
Wetin you and your family need now na COVID-19 Vaccine them dey call am. Make you go collect your vaccine today, or as soon as you hear say dem don get am for your hospitu wey dear near your side.
Go collect the vaccination sharp sharp because this COVID -19 fit worry perosn for their whole life. If you collect the vaccine, you go dey safe. You and your family go dey safe. Make you get di COVID-19 vaccine now so dat you and your family pipu go dey safe.
Na this COVID-19 vaccine go help you and your family and even your neighbours dey safe.
Make we join hand build awa community back so dat e go dey stronger dan eva. Make you get di COVID-19 vaccine as soon as you fit get am.
Make you get di COVID-19 vaccine now and help protect your family and people dem.
No one dey safe until everyone dey safe. Make you protect yasef and community pipu and get di COVID-19 vaccine.
Life better than make pesin just die anyhow. Go collect the vaccine quick quick so dat you no go get de serious gbege illness wey COVID-19 dey cause!
Fear of Needles
Quick "jab" dey beta dan to dey to COVID-19 wey serious gan. Make sure sey you go collect the vaccinaction as soon as you fit get am.
Trust and Safety
Q: COVID-19 vaccine dey cause serious kasala for body after your collect am? A: After you collect the COVID-19 vaccine, your wey you take collecting the injection fit pain you small, and your bodi fit hot small or you go dey tired but serious problem no dey happen lile that
Q: The Vaccine dey safe for women wey carry belle? A: Vaccine dey safe for women wey carry belle , or dos who wan get belle. Make you protect yasef and get di C-19 vaccine!
Q: COVID-19 vaccines dey work? A: Dem don confirm say all COVID-19 vaccines wey dem government approve dey work and even if pipu no carry luck come get the COVID-19 e no go dey serious wey person go die. No wait oh! Make you take di COVID-19 vaccine to protect yasef and odas.
Q: All de COVID-19 vaccines dey safe? A: De COVID-19 vaccine for clinic wey dem approve for Nigeria dey work the way oda COVID-19 vaccines for oda place dey work. Make you go collect ya own as soon as you fit collect am so that your bodi go de kampe!
Q: Wetin make I fear inside the COVID-19 Vaccine? A: My brother/sister,e better make your fear COVID-19 disease pass to dey worry about how your bodi go dey do you after you collect the vaccine .
Q: Afta I don get my vaccine, I fit stop to dey wear mask or to dey wash my hands? A: E go better make you no stop so you go helep other pipu when never get COVID-19 before. , make you get collect all the COVID-19 vaccine. Even if you don aleady get COVID-19 before.
No carry False Stori about COVID-19 - COVID-19 Mythbusters
False: COVID-19 vaccines fit cause make man and woman no fit get children. True: No evidence wey support this kain talk. The vaccine go save your live so that you go get long life and born the children wey you dey look for.
False: COVID-19 vaccines make women womb spoil and she no go fit carry belle. True: You fit no see your menses on the day when you see am after you collect the vaccine , but no worry, e go show! but e never happen say pesin wey collect the vaccine no fit born pikin
False: COVID-19 vaccines dey cause make man no fit get pikin. True: No evidence dey to show say COVID-19 vaccine dey affect when man or woman fit get pikin . Make you protect yasef and get di COVID-19 vaccine!
False: COVID-19 vaccines dey make pipu die. True: If you take COVID-19 vaccines and god forbid, the COVID-19 still come catch you, e no got serious reach wey dem go admit you for hospital. E go tay before you even see say kasala burst COVID-19 vaccine dey save life.
False: If you get vaccine, you go get COVID-19. True: Lai lai, you no fit get COVID-19 sickness if you collect the. COVID-19 vaccine dey save life.
False: COVID-19 vaccines dey make pipu die. True: E dey very possible for COVID-19 to kill pesin if dem never get di COVID-19 vaccine dan if dem don collect the vaccine. COVID-19 vaccines dey save lives.
Faith Leaders
Pastor and Imam dey shout o say make community pipu come collect di COVID-19 vaccine make e protect dia health.
Availability( E dey)
You know say di COVID-19 booster don dey available now for Nigeria? Go collect the booster injection quick quick extra protection for COVID-19 if dem tell you say you don reach to collect am .
COVID-19 vaccine dey *free*? Make you protect yasef and odas and, collect the vaccine!
Gender Norms and Barriers
We dey get di vaccine because say we wan keep awa community strong and healthy!
Make you support women for ya community make dem also collect di COVID-19 vaccine. You know say e no easy for women to commot go collect the vaccine. Dem fit no get money for transport or to comot for house. Make we all join hand together make sure say, road no block for woman to collect vaccine..
Everyone get di right to get COVID-19 vaccines. Government pipu, patient advocacy group and doctor and nurse fit work togeda so dat dem go make sure say women and gender-diverse pipu fit get C-19 vaccines and health services.
Public health ogas must listen to women so dat dem go understand how dem go take reach dem wit correct information about COVID-19 vaccine. E go better make dem employ women wey dey give vaccines and to dey make sure say e safe, place wey man and woman fit work bi di key o!
Disability Inclusion
Pipu wit hand or leg dey pain dey get unfair treatment by COVID-19. E dey serious to make sure say pipu dey always get information, and where them fit go if them want informate about COVID-19 or them wan treatment.
E no dey easy for pipu wey hand or leg dey pain to commot go anywhere. We gas to make sure these people go fit enter hospital or where dem dey give COVID-19 vaccine. Make sure say dis pipu for ya community fit get di information dem nid so dat dem go fit get di COVID-19 vaccine!
Pipu wey hand or leg dey pain or no fit waka no go find am eady to come to where dem dey collect COVID-19 vaccine . Make government make sure say everybodi fit get di COVID-19 vaccine!
Graphics
Instagram/Facebook
Credits:
Cover photo: CORE Group Polio Project / South Sudan